Celebrities, influencers and plenty fans of Nigerian actress Moyo Lawal don come out to hail her afta she tok say she still dey strong, stand gidigba and she neva lost her faith.
Ms Lawal bin make headlines wen her private video bin go viral on social media for recently.
Although she bin don tok say she dey plan to take legal action against her whoever leak di tape.
She identify di man wey bin dey di video wit her as her ex-fiancé.
For one new post on her verified Instagram account wey she title ‘A time to Heal’, di actress bin shed more light on life afta her sex video wey leak.
Nollywood actors like Kate Henshaw, Omoni Oboli, Empress Njamah, Adeniyi Johnson, Tayo Odueke, among odas express support and solidarity for di actress.
0 Comments